Omoh life no easy. If
you reason am the only time that was relaxed and fun in someone’s life was when
we were still in university walai but it was so stressful and uncomfortable to
us back then, was almost like the end of the world, parents will send you
pocket money, u will even scam sef and add on top it just to flex, it was the
life. After school, na there stage 2 of life start, to get anything na by
hustling, you gats find something wey go dey give you money on a steady if you
no wan suffer die.
That’s why Abuja people
have mastered the art of Packaging which
is the ancient art of wrapping your yama yama or your reality with gold crusted
wrapping sheet, it’s like using golden leaves to wrap your akpu (fufu).
You will see a girl that’s
on point, dressed like a fashion blogger, with iPhone and on point braids
carrying Michael korrs bag but she fit never chop since morning because money
no dey anywhere, infact even to go work, na by are you going towards gwarinpa? Let me join you please. You will
see a guy looking all fresh in his Honda, nice wrist watch, clean, rent he
never pay but go still dey hustle woman dey go club dey pile up bills. You will
see a married woman that knows her husband is trying to make her comfortable
but she will be wearing the most expensive George and Ankara to pose.
Person go be carpenter
tell you say na imported furniture expert, person go be pimp tell you say na
business man, Person papa go get boys wey go dey help am push drugs dey tell
you say na politician or business man too. Person go dey jobless go tell you say
na government work so him fit dey do another business and na lie. Person sef
like girls, gats lie say dem done travel out, make e no be like say dem no
follow for civilization. Even Person wey be harlot go package like one holy
maló chick wey never sabi anything. In this town, to survive, you have to
package well like fried rice.
No comments:
Post a Comment