Dear
Diary, 12/08/15
Omo which kind
life be this for this Abj, town too cost, everything just dey somehow. Today
marks six months since I entered this town and mehn it’s not been easy. Within
this short time you won’t believe what I’ve been through financially, looking for
money not even the one to spend on clothes and iPhone 6 o, na to just make I
get transport to dey go work and make I dey see food chop on a daily. you would
think that entering Abj everything go just soft, I go just meet one rich malo
guy wey go just love me stupidly just dey spoil me but lai lai I never even
meet one, all the ones wey I dey meet na Igbo boys wey stingy die and wan chuke
before I even see 3k, like yesterday now I went to see Emeka and the idiot gave
me 1k for cab to Lugbe and I ended up paying 1500, that's 500 extra from my
money o wey I been wan use buy eggs for my indomie and the guy still shag
for free. mtcheew. My problems plenty, fear sef no even let me ask Demola for
money since he gave me 10k last week, what did I even use it to do? Okay
I used 5k to pay DSTV I mean 6k as this stupid dstv people decided to increase
their fees for no reason, the remaining 4k I’ve been using it as tp to go to
work. kai When salary comes now, from the 30k, I’ll buy gas 3k, pay Stella the
5k I borrowed from her to pay for the top Aisha forced me to buy, and her
prices are so high always cheating people mtcheew, and I just had to buy because
she was on my neck, that’s 8k gone o and I have to pay for light units 5k that’s
13k gone from 30k and I never even remove transport sef and food stuff money.
shey if I had a car now, tp won’t be an issue just fuel. Ehen I’ll call Michael
again and remind him,I really need that 20k I hope he gives me this week sha.
Aswear I done tire, let me even remind Ben about the money he said he'll give
me for my hair, it’s so old I’ll just fix centre parting with that my chocolate
abeg instead of braiding again. Rent sef, anyways its till may next year so i
still have 7months left.
I can’t wait to be
rich and not have to beg all these guys that will be forming and even ignoring
you and wanting to shag first before they give somebody peanuts. But kai which
business will I do now?
No comments:
Post a Comment